Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • yc lesson 11 pp. 24-25
  • People Wey Write About Jesus

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • People Wey Write About Jesus
  • Teach Your Pikin
  • Similar Material
  • Who Jesus Christ Be?
    Wetin Bible Dey Teach Us?
Teach Your Pikin
yc lesson 11 pp. 24-25
People wey write about Jesus—Matthew, Mark, Luke, John, Peter, James, Jude, and Paul

LESSON 11

People Wey Write About Jesus

You see the people wey dey this picture?— Their name na Matthew, Mark, Luke, John, Peter, James, Jude, and Paul. All the people dey for the same time wey Jesus dey this world. Make we learn more about dem.

Wetin you sabi about this people?

Three of dem na apostle wey preach with Jesus. You know who the three be?— Na Matthew, John, and Peter. Apostle Matthew and John sabi Jesus well well, and dem write book about wetin Jesus do when e dey for this world. Apostle John still write Revelation, First John, Second John, and Third John. Na apostle Peter write First Peter and Second Peter for Bible. For Second Peter, e write about the time when Jehovah talk from heaven sey: ‘Na my pikin be this. I like am well well, e dey make me happy.’’

The other people for the picture still teach us about Jesus for the book wey dem write. One of dem na Mark. E be like sey e dey there when dem arrest Jesus and e see everything wey happen. Another person na Luke. Na doctor e be. E fit be sey na after Jesus die e come be Christian.

Two other people wey write Bible na Jesus brother. Jesus senior dem. You know their name?— Their name na James and Jude. Dem no first believe Jesus. Dem even think sey e no get sense. But after, dem believe am, dem come be Christian.

The last person wey dey the picture wey write Bible na Paul. But na Saul be im name before e come be Christian. E no like Christian and e dey wicked dem. You know wetin make Paul want be Christian?— Paul dey travel for road one day, na im e just hear person dey talk to am from heaven. Na Jesus! E ask Paul: ‘Why you dey wicked people wey dey follow me?’ After that one, Paul come be Christian. Paul write 14 book for inside Bible, na im write Romans go reach Hebrews.

We dey read Bible everyday, no be so?— If we dey read Bible, we go learn many things about Jesus. You go like to learn other things about Jesus?—

READ AM FOR YOUR BIBLE

  • 2 Peter 1:16-18

  • Mark 3:21; 14:51

  • Jude 1

  • Acts 9:1-18

QUESTION:

  • Which Jesus apostle write about am?

  • Which two people wey write Bible be Jesus brother?

  • How Paul take be Christian?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share