Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Pidgin (West Africa)
  • BIBLE
  • PUBLICATIONS
  • MEETINGS
  • lfb lesson 57 p. 138-p. 139 par. 1
  • Jehovah Send Jeremiah Go Preach

Video no dey for wetin you select.

Sorry, the video no go fit play.

  • Jehovah Send Jeremiah Go Preach
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 57 p. 138-p. 139 par. 1
Jeremiah scatter one pot wey dem make with sand sand for the elders front

LESSON 57

Jehovah Send Jeremiah Go Preach

Jehovah send Jeremiah go Judah as prophet. E tell am sey make e preach to the people and warn dem sey make dem stop to dey do bad bad things. Jeremiah come tell Jehovah sey: ‘But Jehovah, I be small pikin. I no know how I go take talk to the people.’ Jehovah come tell am sey: ‘No fear. I go tell you wetin you go talk. I go help you.’

Jehovah tell Jeremiah make e gather all the elders and make e scatter one pot wey dem make with sand sand for their front and sey: ‘Na so Jerusalem go scatter.’ As Jeremiah do wetin Jehovah tell am, the elders come dey vex well well. One priest wey dem dey call Pashhur beat Jeremiah, e even chain Jeremiah hand and leg for wood wey dem put hole. Jeremiah no fit move im body for the whole night. When day break, Pashhur come allow am go. Jeremiah come sey: ‘I no go fit again, I want stop to dey preach.’ But you think sey e really do wetin e talk? For where! As e think about am well well, e come sey: ‘Wetin Jehovah send me be like fire for my body. I no fit stop to dey preach.’ True true, e continue to dey warn the people.

After many years, Judah people come get new king. The priest and the lie lie prophet no like wetin Jeremiah dey preach. Dem come tell the elders sey: ‘Make we kill am.’ Jeremiah tell dem sey: ‘If una kill me, na person wey no do any bad thing una kill. Na wetin Jehovah tell me I dey talk, no be my own.’ When the elders hear wetin e talk, dem sey; ‘Make we no kill am.’

Jeremiah no stop to dey preach, this one come make the elders dey vex for am. Dem tell the king sey make e kill Jeremiah. The king tell dem sey make dem do am anything wey dem like. Dem come put Jeremiah for one deep hole wey potopoto dey. Dem think sey e go die. Jeremiah come dey go down down for the potopoto.

Ebedmelech and the people wey dey with am dey draw Jeremiah comot for the deep hole

Ebed-melech wey be oga for the palace come tell the king sey: ‘The elders don put Jeremiah for deep hole o! If we leave am for there, e go die o!’ Na im the king tell Ebed-melech and 30 other men sey make dem go draw Jeremiah comot for there. You no think sey e good make we be like Jeremiah wey no let anything stop am to dey preach?

‘People go hate una because of me. But any person wey no tire go reach the end, na im God go save.’—Matthew 10:22

Question: Wetin make Jeremiah obey Jehovah even when e think sey im na small pikin? Which people try to stop Jeremiah to dey preach?

Jeremiah 1:​1-​19; 19:​1-​11; 20:​1-​13; 25:​8-​11; 26:​7-​16; 38:​1-​13

    Publication for Pidgin (West Africa) (2017-2026)
    Log Out
    Log In
    • Pidgin (West Africa)
    • Share
    • How You Want-Am
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • Wetin You Go Do and Wetin You No Go Do If You Want Use This Website
    • How We De Handle Information for This Website
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share