Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Pidgin (West Africa)
  • BIBLE
  • PUBLICATIONS
  • MEETINGS
  • lfb lesson 75 p. 178-p. 179 par. 4
  • Devil Come Test Jesus

Video no dey for wetin you select.

Sorry, the video no go fit play.

  • Devil Come Test Jesus
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 75 p. 178-p. 179 par. 4
Jesus no gree jump from the place wey high pass for the temple

LESSON 75

Devil Come Test Jesus

Jesus no gree turn stone to bread

After Jesus baptize finish, holy spirit lead am go desert. Because Jesus no chop anything for 40 days, e come dey hungry. Devil come test am. E tell Jesus sey: ‘If you sey you be really God Son, turn all this stone to bread.’ But Jesus tell am wetin dem don write before, when e sey: ‘Dem don write am sey, “No be only food go give you life, but na to listen to all the things wey Jehovah talk.” ’

Devil come still tell Jesus sey: ‘If you sey you be really God Son, jump go down from the temple. Dem don write am sey God go send im angel come catch you.’ But Jesus still tell am wetin dem don write before, when e sey: ‘Dem don write am sey make you no test Jehovah.’

Jesus no gree take the kingdom wey Satan dey give am

Satan come still test Jesus again. E show am all the kingdom wey dey the world and the fine fine things wey dey. E tell am sey: ‘I go give you all this kingdom and the fine things wey dey, if you bow down for me only once.’ But Jesus answer am sey: ‘Comot for here Satan! Dem don write am sey na only Jehovah you go worship.’

Satan come waka leave Jesus. God come send some angel come give Jesus food chop. Na from that time Jesus come dey preach the good news about God Kingdom. Na that work God send am come do for earth. People like wetin Jesus dey teach dem no be small, na im make dem dey follow am go anywhere e go.

‘When [Devil] lie, e dey talk am with all im mind because na liar e be and na im be the papa of lie.’—John 8:44

Question: Wetin be the three things wey Satan take test Jesus? How Jesus take answer am?

Matthew 4:​1-​11; Mark 1:​12, 13; Luke 4:​1-​15; Deuteronomy 6:​13, 16; 8:3; James 4:7

    Publication for Pidgin (West Africa) (2017-2026)
    Log Out
    Log In
    • Pidgin (West Africa)
    • Share
    • How You Want-Am
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • Wetin You Go Do and Wetin You No Go Do If You Want Use This Website
    • How We De Handle Information for This Website
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share