Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Pidgin (West Africa)
  • BIBLE
  • PUBLICATIONS
  • MEETINGS
  • lfb lesson 82 p. 192-p. 193 par. 2
  • Jesus Teach Im Disciples How to Pray

Video no dey for wetin you select.

Sorry, the video no go fit play.

  • Jesus Teach Im Disciples How to Pray
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Other Materials Like This One
  • Prayer Na Gift From God
    Wetin Bible Fit Teach Us?
  • Come Near God for Prayer
    Enjoy Life Now and Forever!—Study and Learn From Bible
  • Jehovah De Hear Our Prayer?
    Obey God and You Go Live Forever
  • Show Say You Value Prayer
    Watchtower Wey E De Announce Jehovah’s Kingdom (Study)—2022
See other things
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 82 p. 192-p. 193 par. 2
One Pharisee person dey pray for where people dey and people dey look am

LESSON 82

Jesus Teach Im Disciples How to Pray

Pharisee people dey do everything to make people praise dem. If dem do better thing at all, na because dem want make people know dem. Dem dey pray for where many people dey, make everybody for see dem. Dem dey cram long prayer. And dem dey pray am for where people dey worship and for corner of road make people wey dey pass for hear dem. So, people surprise when Jesus tell dem sey: ‘Make una no dey pray like Pharisee people. Dem dey think sey God go hear dem because dem dey pray long prayer, but no be so. Na only you and God suppose know wetin you dey pray about. No dey talk the same thing everytime. Jehovah want make you dey pray to am from your mind.

One boy kneel down dey pray

‘You suppose to dey pray like this, sey: “Our Father wey dey heaven, make your name dey holy. Make your Kingdom come. Make wetin you get for mind for this earth happen as e dey happen for heaven.” ’ Jesus still teach dem sey make dem pray make God give dem food wey dem go chop for that day, make God forgive dem. And make dem still pray about their own matter.

Jesus tell dem sey: ‘Make una no stop to dey pray. Make una continue to dey beg Jehovah for better things. All papa and mama want give their pikin better things. If your pikin sey make you give am bread, you go give am stone? If e sey make you give am fish, you go give am snake?’

Jesus come tell dem wetin e mean, sey: ‘If you fit give your pikin better thing, na Jehovah no go come give you holy spirit? Wetin you need to do, na to pray.’ You dey follow wetin Jesus talk? Which things you dey pray about?

‘Continue to dey ask and dem go give una, continue to dey find and una go see am, continue to dey knock and dem go open for una.’—Matthew 7:7

Question: Wetin Jesus tell im disciples when e dey teach dem how to pray? You dey pray about wetin you really need?

Matthew 6:​2-​18; 7:​7-​11; Luke 11:13

    Publication for Pidgin (West Africa) (2017-2026)
    Log Out
    Log In
    • Pidgin (West Africa)
    • Share
    • How You Want-Am
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • Wetin You Go Do and Wetin You No Go Do If You Want Use This Website
    • How We De Handle Information for This Website
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share