Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Pidgin (West Africa)
  • BIBLE
  • PUBLICATIONS
  • MEETINGS
  • lfb lesson 88 p. 206-p. 207 par. 4
  • Dem Catch Jesus

Video no dey for wetin you select.

Sorry, the video no go fit play.

  • Dem Catch Jesus
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 88 p. 206-p. 207 par. 4
Judas sell Jesus for the garden of Gethsemane

LESSON 88

Dem Catch Jesus

Jesus and im apostles waka pass Kidron go the mountain wey dey Olive. Na after midnight when moon don dey come out well well dem go. When dem reach the garden of Gethsemane, Jesus tell dem sey: ‘Make una dey here and continue to dey watch.’ Jesus come go front for the garden and kneel down dey pray. Jesus pray to Jehovah with the pain wey e dey feel, e sey: ‘Make wetin you want happen.’ Na im Jehovah send one angel go help am. When Jesus come meet im apostles back, e see dem dey sleep. E tell dem sey: ‘Make una wake up! No be time to dey sleep be this. Time don reach wey person go sell me give my enemy.’

Dem dey give Judas bag of money

E no tey, Judas come with many people wey carry sword and stick. E know sey e go see Jesus for here because, e dey follow Jesus and other apostles come here before. Judas don tell the soldiers wetin e go do to show dem Jesus. E go meet Jesus, na im e tell am sey: ‘Teacher, I greet you o!’ E come kiss am. Jesus come tell am sey: ‘Judas, you dey sell me with kiss?’

Jesus come ask the people sey: ‘Who una dey find?’ Dem tell am sey: ‘We dey find Jesus wey come from Nazareth.’ Jesus come answer dem sey: ‘Na me.’ As dem hear am, dem draw body go back come fall for ground. Jesus come ask dem again sey: ‘Who una dey find? Dem answer am again sey: ‘We dey find Jesus wey come from Nazareth.’ Jesus come answer dem sey: ‘I don tell una sey, na me! Leave this people make dem go.’

As Peter see as things dey happen, e bring im sword come out come cut one of the high priest slave ear. Jesus come touch the slave ear, the ear come gum back. E come tell Peter sey: ‘Drop your sword. If you fight with sword, na sword dem go take kill you.’ The soldiers come hold Jesus and tie im hand. Many of the apostles come tear race. Dem come carry Jesus go meet Annas wey be chief priest. After Annas ask Jesus many many question finish, e sey make dem carry am go meet Caiaphas wey be high priest. But wetin come happen to the apostles?

‘For this world, wahala go dey well well, but make una no fear! I don win the world.’—John 16:33

Question: Wetin happen for the garden of Gethsemane? Wetin you fit learn from wetin Jesus do that night?

Matthew 26:​36-​57; Mark 14:​32-​50; Luke 22:​39-​54; John 18:​1-​14, 19-​24

    Publication for Pidgin (West Africa) (2017-2026)
    Log Out
    Log In
    • Pidgin (West Africa)
    • Share
    • How You Want-Am
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • Wetin You Go Do and Wetin You No Go Do If You Want Use This Website
    • How We De Handle Information for This Website
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share