Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Pidgin (West Africa)
  • BIBLE
  • PUBLICATIONS
  • MEETINGS
  • lfb lesson 8 p. 26-p. 27 par. 1
  • Abraham and Sarah Obey God

Video no dey for wetin you select.

Sorry, the video no go fit play.

  • Abraham and Sarah Obey God
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Other Materials Like This One
  • You De Wait for “the City Wey Get Correct Foundation”?
    Watchtower Wey E De Announce Jehovah’s Kingdom (Study)—2020
  • Jehovah Test Im Faith
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Sarah Don Born Pikin!
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 8 p. 26-p. 27 par. 1
Abraham and Sarah dey pack their things dey comot for Ur

LESSON 8

Abraham and Sarah Obey God

Ur na another place wey no too far from Babel, and people dey worship many many gods for there. But e get one man wey dey worship only Jehovah. Im name na Abraham.

Jehovah tell Abraham sey: ‘Comot for your house and leave your people, and go the land wey I go show you.’ God come promise am sey: ‘You go be big country, and I go do better thing for many people for the whole earth because of you.’

Abraham no know where Jehovah sey make e go, but e believe sey to do wetin Jehovah want na im better pass. So Abraham, im wife Sarah, im papa Terah, and im brother pikin Lot pack all their things come start to dey travel.

Abraham dey 75 years when im and im family reach the land wey Jehovah want make dem stay. The land na Canaan. Na there God for promise Abraham sey: ‘You see all this land wey dey around you, I go give am to your children.’ But Abraham and Sarah don old and dem never born any pikin. So how Jehovah promise go take happen?

Abraham and im family dey travel go Canaan

‘Na with faith Abraham take obey God, to go the place wey e go give am; e start to dey go even as e no know where e dey go.’—Hebrews 11:8

Question: Wetin Jehovah sey make Abraham do? Wetin be the two things wey Jehovah promise Abraham?

Genesis 11:29–​12:9; Acts 7:​2-4; Galatians 3:6; Hebrews 11:8

    Publication for Pidgin (West Africa) (2017-2026)
    Log Out
    Log In
    • Pidgin (West Africa)
    • Share
    • How You Want-Am
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • Wetin You Go Do and Wetin You No Go Do If You Want Use This Website
    • How We De Handle Information for This Website
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share