Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Pidgin (West Africa)
  • BIBLE
  • PUBLICATIONS
  • MEETINGS
  • lfb lesson 10 p. 30-p. 31 par. 5
  • Lot Wife No Obey Jehovah

Video no dey for wetin you select.

Sorry, the video no go fit play.

  • Lot Wife No Obey Jehovah
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Other Materials Like This One
  • Help Other People Manage Stress
    Watchtower Wey E De Announce Jehovah’s Kingdom (Study)—2019
  • Remember the Wife of Lot
    Our Christian Life and Preaching—Meeting Workbook—2018
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 10 p. 30-p. 31 par. 5
Lot wife turn to salt as Lot and im two pikin dey run from Sodom

LESSON 10

Lot Wife No Obey Jehovah

Lot stay with Abraham wey be im papa brother for Canaan. As time dey go, Abraham and Lot come get many many animal sotey the land no reach dem again. Abraham come tell Lot sey: ‘We no go fit continue to stay for the same place. Abeg choose where you go like go, and I go go the other side.’ This one show sey Abraham no dey think about only imself.

Lot see one fine land wey near Sodom. The land get better grass and plenty water. So e choose that land and carry im family go there. Dem come dey stay there.

The people wey dey stay Sodom and the land wey near am wey be Gomorrah bad well well. Even self, dem dey do bad things sotey Jehovah come sey e go destroy dem. But God want save Lot and im family, so e send two angel go warn dem sey: ‘Make una comot for this city quick quick, Jehovah want destroy am.’

Lot no comot as dem tell am. E dey draw leg for back. So the angel hold Lot, im wife and im two pikin wey be girl for hand and rush dem comot for the city. E tell dem sey: ‘Make una run for una life, make anybody no look back, if anybody look back, e go die!’

Fire and sulfur dey fall like rain for Sodom and Gomorrah

When dem reach the place where dem dey call Zoar, Jehovah use fire and sulphur wey fall like rain take destroy the two city finish. As dem dey go, Lot wife look back, e come turn to salt! But Lot and im two pikin no turn to salt because dem obey Jehovah. E pain dem well well sey Lot wife look back. But dem happy sey dem do wetin God talk.

‘Remember Lot wife.’—Luke 17:32

Question: Why Jehovah destroy Sodom and Gomorrah? Wetin make Lot wife turn to salt?

Genesis 13:​1-​13; 19:​1-​26; Luke 17:​28, 29, 32; 2 Peter 2:​6-9

    Publication for Pidgin (West Africa) (2017-2026)
    Log Out
    Log In
    • Pidgin (West Africa)
    • Share
    • How You Want-Am
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • Wetin You Go Do and Wetin You No Go Do If You Want Use This Website
    • How We De Handle Information for This Website
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share