Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Pidgin (West Africa)
  • BIBLE
  • PUBLICATIONS
  • MEETINGS
  • lfb lesson 31 p. 78-p. 79 par. 3
  • Joshua and Gibeon People

Video no dey for wetin you select.

Sorry, the video no go fit play.

  • Joshua and Gibeon People
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Other Materials Like This One
  • Joshua 1:9—“Dey Strong and Get Strong Heart”
    Bible Verse Wey Them Don Explain
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 31 p. 78-p. 79 par. 3
Gibeon people wear tear tear cloth dey come meet Joshua and im soldier

LESSON 31

Joshua and Gibeon People

Other city hear sey Israel people don scatter Jericho. Their king come plan together to fight Israel people. But Gibeon people no join dem, dem get another plan. Dem wear tear tear cloth go meet Joshua and tell am sey: ‘The land wey we come from far well well. We don hear many things about Jehovah and everything wey e do for una for Egypt and Moab. If una promise us sey una no go come fight us, we go be una slave.’

Joshua believe dem and e tell dem sey e no go come fight dem. After three days, e come see sey where dem dey stay no far. Dem come from Canaan. Joshua come ask dem sey: ‘Wetin make una lie for us?’ Dem answer am sey: ‘Na fear catch us. We know sey Jehovah dey fight for una. Abeg make una no kill us.’ True true, Joshua no kill dem as e promise.

E no too tey, five king wey come from Canaan come dey threaten Gibeon people. As Joshua hear am, im and im soldier march round the city the whole night to protect dem. The fight start for early morning. Na so Canaan people start to dey run anyhow. But anywhere dem run go, Jehovah send ice block wey dey fall like rain for their head. Joshua come tell Jehovah sey make the sun no comot. Why Joshua go tell Jehovah sey make sun no comot when that kind thing never happen before? Na because e believe sey Jehovah go fit do am. True true, the sun no comot for the whole day until Israel people finish Canaan and their soldier.

Joshua dey look heaven dey tell Jehovah sey make the sun no comot

‘If you sey “Yes” make e be yes, and if you sey “No” make e be no, anything wey pass this one na from the wicked person.’—Matthew 5:​37

Question: Wetin Gibeon people do to save theirself? How Jehovah take help Israel people?

Joshua 9:1–​10:15

    Publication for Pidgin (West Africa) (2017-2026)
    Log Out
    Log In
    • Pidgin (West Africa)
    • Share
    • How You Want-Am
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • Wetin You Go Do and Wetin You No Go Do If You Want Use This Website
    • How We De Handle Information for This Website
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share