Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Pidgin (West Africa)
  • BIBLE
  • PUBLICATIONS
  • MEETINGS
  • lfb lesson 35 p. 86-p. 87 par. 1
  • Hannah Beg Jehovah for Pikin

Video no dey for wetin you select.

Sorry, the video no go fit play.

  • Hannah Beg Jehovah for Pikin
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Other Materials Like This One
  • Allow Jehovah to Give You Peace of Mind
    Watchtower Wey E De Announce Jehovah’s Kingdom (Study)—2020
  • Tell Jehovah How You De Feel for Prayer
    Our Christian Life and Preaching—Meeting Workbook—2022
  • Jehovah De See Your Tears and E Care About You
    Watchtower Wey E De Announce Jehovah’s Kingdom (Study)—2024
  • Do Wetin Go Make Peace Dey, and No Try to Better Pass Your Brother
    Watchtower Wey E De Announce Jehovah’s Kingdom (Study)—2021
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 35 p. 86-p. 87 par. 1
Hannah dey give Samuel to Eli for tabernacle

LESSON 35

Hannah Beg Jehovah for Pikin

Elkanah wey be Israel person marry two wife. Their name na Hannah and Peninnah, but na Hannah e like pass. Peninnah dey use Hannah do yeye everytime because Hannah no get pikin but e get many pikin. Every year, Elkanah dey carry im family go worship Jehovah for tabernacle wey dey Shiloh. When dem dey there, e see am sey Hannah no happy. E come sey: ‘Abeg no cry. I dey with you. I love you!’

Later, Hannah comot go pray. E dey cry as e dey beg Jehovah make e help am. E promise Jehovah sey: ‘Jehovah, if you give me pikin, I go give you back, and e go use all im life serve you.’

High Priest Eli see Hannah dey cry as e dey pray

Eli wey be high priest see Hannah dey cry come out, e come think sey e don drink. Hannah come tell am sey: ‘No be so my lord, I never drink. I get big problem and I dey tell Jehovah about am.’ Eli come see sey wetin e dey think no be true. E come tell Hannah sey: ‘God go give you wetin you want.’ Hannah mind come down, e come comot. After some time, e come born boy and give am Samuel. You no think sey Hannah go happy well well?

Hannah no forget wetin e don promise Jehovah. As Samuel grow small, e carry am go tabernacle. E tell Eli sey: ‘Na the pikin wey I pray make God give me be this. E go use all im life work for Jehovah.’ Elkanah and Hannah dey go visit am every year and dem dey buy new coat for am. Jehovah make Hannah born three boys and two girls join Samuel.

‘Continue to dey ask and dem go give una, continue to dey find and una go see am.’—Matthew 7:7

Question: Wetin make Hannah no happy? How Jehovah take bless am?

1 Samuel 1:1–​2:​11, 18-​21

    Publication for Pidgin (West Africa) (2017-2026)
    Log Out
    Log In
    • Pidgin (West Africa)
    • Share
    • How You Want-Am
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • Wetin You Go Do and Wetin You No Go Do If You Want Use This Website
    • How We De Handle Information for This Website
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share