Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Pidgin (West Africa)
  • BIBLE
  • PUBLICATIONS
  • MEETINGS
  • lfb lesson 93 p. 216-p. 217 par. 5
  • Jesus Go Back to Heaven

Video no dey for wetin you select.

Sorry, the video no go fit play.

  • Jesus Go Back to Heaven
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Other Materials Like This One
  • Jesus Preach About God Kingdom
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • “Una Go Tell People About Me”
    De “Preach Well About the Kingdom of God”
  • God Give Jesus Disciples Holy Spirit
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 93 p. 216-p. 217 par. 5
Jesus dey go up as im apostles dey look am

LESSON 93

Jesus Go Back to Heaven

Jesus meet im disciples for Galilee. E come give dem important command sey: ‘Make una go make people my disciple for the whole world. Make una teach dem wetin I teach una, and make una baptize dem.’ E come promise dem sey: ‘Make una remember sey, I go always dey with una.’

For the 40 days wey Jesus stay this earth after God bring am back to life, e appear to many of im disciples for Galilee and Jerusalem. E teach dem fine fine lesson and e do many miracle. Jesus come meet im apostles for the mountain wey dey Olive for the last time. E don tell im apostles before sey: ‘Make una no comot for Jerusalem. Make una continue to dey wait for wetin my Father don promise.’

But im apostles no understand wetin e mean. So dem ask am sey: ‘Na now God want make you King for Israel?’ Jesus answer dem sey: ‘Time wey Jehovah go make me King never reach. But holy spirit go soon give una power and una go dey talk wetin una know about me. Make una go preach for Jerusalem, Judea, Samaria, and even the place wey far pass for the earth.’

Na im Jesus start to dey go up. As e dey go, cloud cover am. Im disciples continue to dey look up, until e go finish.

The disciples come comot from the mountain wey dey Olive go Jerusalem. Dem dey always meet for the room wey dey upstair and dem still dey pray for there. Dem dey wait make Jesus tell dem other things about the work wey e give dem.

‘People go dey preach this good news about God Kingdom for everywhere for this world make everybody fit hear, after this one, the end go come.’—Matthew 24:14

Question: Wetin Jesus command im disciples? Wetin happen for the mountain wey dey Olive?

Matthew 28:​16-​20; Luke 24:​49-​53; John 20:​30, 31; Acts 1:​2-​14; 1 Corinthians 15:​3-6

    Publication for Pidgin (West Africa) (2017-2026)
    Log Out
    Log In
    • Pidgin (West Africa)
    • Share
    • How You Want-Am
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • Wetin You Go Do and Wetin You No Go Do If You Want Use This Website
    • How We De Handle Information for This Website
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share