Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Pidgin (West Africa)
  • BIBLE
  • PUBLICATIONS
  • MEETINGS
  • lfb lesson 102 p. 236-p. 237 par. 2
  • The Things Wey John See

Video no dey for wetin you select.

Sorry, the video no go fit play.

  • The Things Wey John See
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Other Materials Like This One
  • Wetin Be the Kingdom of God?
    Wetin Bible Fit Teach Us?
  • “See! Plenty People”
    Watchtower Wey E De Announce Jehovah’s Kingdom (Study)—2019
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 102 p. 236-p. 237 par. 2
Apostle John dey write the book of Revelation

LESSON 102

The Things Wey John See

When apostle John dey prison for the island wey dey Patmos, Jesus show am things wey go happen for front one by one. The things wey e see reach 16. All of dem show how Jehovah name go take dey holy, how im Kingdom go take come, and how everything wey e get for mind go happen for earth as e be for heaven.

One of the thing wey John see be sey, e see Jehovah for im throne for heaven. The throne fine well well and 24 elders dey around am. Dem wear white cloth and dem wear crown wey dem make with gold for their head. Lightening dey shine for the throne, and thunder follow. The 24 elders bow down to worship Jehovah. John still see many people wey person no fit count. The people come from different different place and dem dey speak different different language. All of them dey worship Jehovah. Jesus Christ wey be the Lamb, come dey carry dem go where water dey. This water dey give life wey no dey end. John come still see sey Jesus and the 24 elders start to dey rule for heaven. E still see Jesus dey fight the dragon wey be Satan, and all im demon. Jesus come drive dem comot for heaven come earth.

Jesus and the 144,000 people wey go follow am rule dey the mountain wey dey Zion

John come see one fine picture of the Lamb and the 144,000 people wey go follow am rule. Dem stand for the mountain wey dey Zion for heaven. E still see one angel wey dey fly round the earth. The angel dey tell people sey make dem fear God and praise am.

The next thing wey John see na the war of Armageddon. For the war, Jesus and im soldier win Satan and im people. The last thing wey John come see be sey, peace dey heaven and earth. Dem kill Satan and the people wey dey support am. Everybody for heaven and earth come dey make God name holy, and dem come dey worship only Jehovah.

‘I go make you and the woman be enemy and your pikin and im pikin go still be enemy. E go scatter your head and you go wound am for leg.’—Genesis 3:15

Question: How many things John see? Wetin Jesus go do for the war wey dem dey call Armageddon?

Revelation 1:​1-3; 4:​1-​11; 7:​4, 9-​17; 11:​15-​18; 12:​5-​12; 14:​1, 6, 7; 16:​14, 16; 21:5

    Publication for Pidgin (West Africa) (2017-2026)
    Log Out
    Log In
    • Pidgin (West Africa)
    • Share
    • How You Want-Am
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • Wetin You Go Do and Wetin You No Go Do If You Want Use This Website
    • How We De Handle Information for This Website
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share