Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Pidgin (West Africa)
  • BIBLE
  • PUBLICATIONS
  • MEETINGS
  • lfb lesson 48 p. 116-p. 117 par. 1
  • The Pikin Come Back to Life

Video no dey for wetin you select.

Sorry, the video no go fit play.

  • The Pikin Come Back to Life
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Other Materials Like This One
  • Jehovah Give Elijah Power
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • E Endure Go Reach the End
    Imitate Their Faith
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 48 p. 116-p. 117 par. 1
Elijah dey call the woman wey dey gather firewood

LESSON 48

The Pikin Come Back to Life

Pot of flour and pot of oil

That time wey rain no fall, Jehovah tell Elijah sey: ‘Go Zarephath. One woman wey e husband don die go give you food chop.’ As Elijah reach the city gate, e see one poor woman wey e husband don die dey gather wood. E come tell the woman make e give am water drink. As the woman dey go give am the water, e tell am again sey: ‘Abeg still bring small bread join.’ The woman come sey: ‘I no get bread wey I go give you. Na only small flour and oil wey I go take do bread for me and my pikin I get.’ Elijah come tell am sey: ‘Jehovah don promise sey if you do small bread for me, your flour and oil no go finish until rain fall again.’

The woman come go house go do bread for Elijah. True true, as Jehovah talk am, the woman and im pikin no hungry until rain fall. The pot wey e dey put flour and oil no empty.

But one bad thing come happen. The woman pikin come sick well well and even die. The woman come dey beg make Elijah help am. Elijah come carry the pikin for im hand go the room wey dey upstair for the house. E put am for bed come pray sey: ‘Jehovah, abeg bring this pikin come back to life.’ You know why this thing go surprise everybody if Jehovah do am? Na because nobody don come back to life before. Another thing be sey, this woman and im pikin no come from Israel.

But the pikin come back to life and start to dey live. Elijah tell the woman sey: ‘See! Your pikin don come back to life.’ The woman happy well well, e come tell Elijah sey: ‘You be really man of God. I know because you dey talk only wetin Jehovah tell you and e dey always happen.’

Elijah dey show the woman im pikin wey e don bring back to life

‘Think about bird: Dem no dey plant seed or harvest plant; dem no get store where dem dey keep things, but God dey give dem food chop. Your value no pass their own?’—Luke 12:24

Question: How the woman take show sey e trust Jehovah? How we take know sey Elijah na God prophet?

1 Kings 17:8-24; Luke 4:5, 26

    Publication for Pidgin (West Africa) (2017-2026)
    Log Out
    Log In
    • Pidgin (West Africa)
    • Share
    • How You Want-Am
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • Wetin You Go Do and Wetin You No Go Do If You Want Use This Website
    • How We De Handle Information for This Website
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share