Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • T-30 pp. 1-4
  • Which Kind Book You Think Sey Bible Be?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Which Kind Book You Think Sey Bible Be?
  • Which Kind Book You Think Sey Bible Be?
  • Similar Material
  • How You Think Sey Our Tomorrow Go Be?
    How You Think Sey Our Tomorrow Go Be?
  • Wetin be God Kingdom?
    Wetin be God Kingdom?
  • Suffer Suffer Go Fit End?
    Suffer Suffer Go Fit End?
  • Who Dey Control This World?
    Who Dey Control This World?
See More
Which Kind Book You Think Sey Bible Be?
T-30 pp. 1-4

Which Kind Book You Think Sey Bible Be?

You think sey . . .

  • na book wey people take their sense write?

  • na book wey lie lie story full?

  • na book wey come from God?

SEE WETIN BIBLE TALK

‘God use im spirit take help people write wetin dey inside Bible.’—2 Timothy 3:⁠16, New World Translation.

HOW WETIN BIBLE TALK FIT HELP YOU

E go give you correct answer for all the different different question about life wey dey worry you for mind.—Proverbs 2:​1-5.

E go make your life better if you follow wetin Bible talk.—Psalm 119:105.

E go help you put mind for better tomorrow.—Romans 15:4.

One man and one woman dey read Bible; one family dey enjoy theirself for outside

WE FIT BELIEVE SEY WETIN BIBLE TALK NA TRUE?

Yes, make we see three reason wey go make us believe:

  • Everything wey Bible talk gree from beginning go reach the end. Na about 40 different ­different people write Bible. The time wey dem take write am pass 1,600 years. Many of dem no even sabi who the other person be, still the thing wey dem write carry the same message.

  • Na true story dey inside. Some people wey dey write ­wetin don happen before no dey write for their book sey another country win their country for war. But the people wey write Bible write the mistake wey dem do and the bad things wey their country self do.—2 Chroni­cles 36:15, 16; Psalm 51:1-4.

  • Wetin Bible don talk sey go ­happen must happen. Bible talk how dem go take scatter one city wey dem call Babylon 200 years before e happen. ­(Isaiah 13:​17-​22) E no only tell us how dem go take scatter am, e even talk the name of the ­soldier wey go scatter am.—Isaiah 45:1-3.

    Other things wey Bible talk sey go happen that time, ­happen as Bible take talk am, whether big or small. No be so the Word of God suppose be?—2 Peter 1:21.

MAKE YOU THINK ABOUT THIS QUESTION

Papa, mama, boy and girl pikin

How Bible fit make your life better?

Bible answer this question for ISAIAH 48:​17, 18 and 2 TIMOTHY 3:​16, 17.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share