Who Dey Control This World?
You think sey . . .
na God?
na people?
na Satan?
SEE WETIN BIBLE TALK
Na one wicked person dey control this world.’—1 John 5:19.
Jesus ‘Come to scatter all the work wey devil don do.’—1 John 3:8, New Century Version.
HOW WETIN BIBLE TALK FIT HELP YOU
E go help you know why all this problem dey happen for this world.—Revelation 12:12.
E go help you believe sey this world go better.—1 John 2:17.
WE FIT BELIEVE SEY WETIN BIBLE TALK NA TRUE?
Yes, make we see three reason wey go make us believe:
Satan government no go dey again. Jehovah don talk am sey e go comot Satan. Devil no go fit control this world again. Jehovah promise sey ‘e go finish . . . Devil’ and e go still repair all the things wey Satan don spoil.—Hebrews 2:14, New World Translation.
God don choose Jesus make e rule this world. Satan dey use im power take dey wicked people. But Jesus no be like that. God promise sey when Jesus start to dey rule this world: ‘E go pity poor people and e go save dem from people wey dey use their power suffer dem.’—Psalm 72:13, 14.
God no fit lie. Bible talk sey: ‘Nothing fit make God lie.’ (Hebrews 6:18) If Jehovah promise sey im go do something, make we just get am for mind sey nothing go fit stop am! (Isaiah 55:10, 11) ‘The person wey dey rule this world no go dey again.’—John 12:31.
MAKE YOU THINK ABOUT THIS QUESTION
If the person wey dey rule this world no dey again, how you think sey this world go be?
Bible answer this question for PSALM 37:10, 11 and REVELATION 21:3, 4.