Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Pidgin (West Africa)
  • BIBLE
  • PUBLICATIONS
  • MEETINGS
  • lfb lesson 2 p. 10-p. 11 par. 1
  • God Make the First Man and Woman

Video no dey for wetin you select.

Sorry, the video no go fit play.

  • God Make the First Man and Woman
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Other Materials Like This One
  • How Life First Be for Adam and Eve?
    Obey God and You Go Live Forever
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 2 p. 10-p. 11 par. 1
Adam and Eve dey garden of Eden

LESSON 2

God Make the First Man and Woman

Jehovah make one garden for Eden. Many flower, tree and animal dey there. God come make the first man Adam from sand sand and blow breeze enter e nose. You know wetin come happen? The man come get life! Jehovah tell am sey make e dey control everything for there and make e give all the animal name.

Jehovah tell am one important thing. E tell am sey: ‘You fit chop from the fruit of all the tree wey dey the garden, but no chop from one special tree. If you chop fruit from that tree, you go die.’

After some time, Jehovah sey: ‘I go make person wey go dey help Adam.’ E come make Adam sleep deep sleep and e use one of im bone take make wife for am. The wife name na Eve. Adam and Eve come be the first family. How you think sey Adam feel when God give am im wife? Adam happy well well no be small, e come talk sey: ‘See person wey Jehovah don use the bone wey dey my side make! Last last, I don see person wey be like me.’

Jehovah tell Adam and Eve sey make dem born pikin full this earth. E want make dem work together to make the whole earth paradise or fine place, like the garden of Eden. But no be so things come be. Why? We go learn more from the next lesson.

‘The person wey make dem from beginning, make dem man and woman.’—Matthew 19:4

Question: Which work Jehovah give Adam? Wetin go happen to Adam and Eve if dem chop from the tree wey God sey make dem no chop?

Genesis 1:​27-​31; 2:​7-9, 15-​23; Psalm 115:16; Matthew 19:​4-6

    Publication for Pidgin (West Africa) (2017-2026)
    Log Out
    Log In
    • Pidgin (West Africa)
    • Share
    • How You Want-Am
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • Wetin You Go Do and Wetin You No Go Do If You Want Use This Website
    • How We De Handle Information for This Website
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share