Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Pidgin (West Africa)
  • BIBLE
  • PUBLICATIONS
  • MEETINGS
  • lfb lesson 37 p. 90-p. 91 par. 1
  • Jehovah Talk to Samuel

Video no dey for wetin you select.

Sorry, the video no go fit play.

  • Jehovah Talk to Samuel
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Other Materials Like This One
  • Wetin We Fit Learn From Samuel?
    Our Christian Life and Preaching—Meeting Workbook—2022
  • Na Almighty But He De Care About People
    Watchtower Wey E De Announce Jehovah’s Kingdom (Study)—2018
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 37 p. 90-p. 91 par. 1
Samuel dey open tabernacle door

LESSON 37

Jehovah Talk to Samuel

Eli wey be high priest get two pikin wey dey work for tabernacle as priest. Their name na Hophni and Phinehas. Their two no dey obey Jehovah and dem dey do people anyhow. If Israel people come sacrifice to Jehovah, dem go collect the best meat chop. Eli know sey im pikin dey do all this things, but e no do dem anything. You think sey Jehovah go let this kind thing continue to dey happen?

Even though sey Hophni and Phinehas senior Samuel well well, e no do like dem. Jehovah like Samuel well well. As e dey sleep one night, e hear person dey call im name. Na im e get up, run go meet Eli and tell am sey: ‘See me!’ But Eli tell am sey: ‘I no call you o! Go sleep.’ Samuel go sleep. As e dey sleep, e hear am again. As Samuel hear am the third time, Eli come know sey na Jehovah dey call am. E tell Samuel sey if e hear the person call am again, make e sey: ‘Jehovah, abeg talk. Your servant dey hear you.’

Samuel dey tell Eli wetin Jehovah tell am

Samuel come go sleep. E come hear the person dey call am again sey: ‘Samuel! Samuel!’ E answer am sey: ‘Abeg talk, your servant dey hear you.’ Jehovah tell am sey: ‘Tell Eli sey I go punish im and im family. E know sey im two pikin dey do bad things for the tabernacle but e no do dem anything.’ The next morning Samuel open the tabernacle door as e dey do before. E dey fear to tell Eli wetin Jehovah tell am. But Eli call am, ask am sey: ‘My pikin, wetin Jehovah tell you? Tell me everything.’ True true, Samuel tell am everything.

As Samuel dey grow, Jehovah continue to dey help am. Everywhere for Israel, people know sey Jehovah don choose Samuel to be prophet and judge.

‘Remember your God wey make you now when you still young.’—Ecclesiastes 12:1

Question: How Samuel take different from Hophni and Phinehas? Wetin Jehovah tell Samuel?

1 Samuel 2:​12-​17, 22-​26; 3:​1-​21; 7:6

    Publication for Pidgin (West Africa) (2017-2026)
    Log Out
    Log In
    • Pidgin (West Africa)
    • Share
    • How You Want-Am
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • Wetin You Go Do and Wetin You No Go Do If You Want Use This Website
    • How We De Handle Information for This Website
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share