Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Pidgin (West Africa)
  • BIBLE
  • PUBLICATIONS
  • MEETINGS
  • lfb lesson 53 p. 128-p. 129 par. 5
  • Jehoiada—Priest Wey Get Mind

Video no dey for wetin you select.

Sorry, the video no go fit play.

  • Jehoiada—Priest Wey Get Mind
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Other Materials Like This One
  • Why E Dey Important Make We De Fear Jehovah?
    Watchtower Wey E De Announce Jehovah’s Kingdom (Study)—2023
  • Jehovah De Bless People Wey Get Strong Heart
    Our Christian Life and Preaching—Meeting Workbook—2023
  • One Wicked Woman Wey No Escape Punishment
    Our Christian Life and Preaching—Meeting Workbook—2022
  • Wetin Dey Part 9
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
See other things
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 53 p. 128-p. 129 par. 5
High Priest Jehoiada dey show the people King Jehoash

LESSON 53

Jehoiada—Priest Wey Get Mind

Jezebel born one pikin wey wicked like am, dem dey call the pikin Athaliah. Athaliah marry Judah king. When the king die, e pikin start to dey rule. But as the pikin die, Athaliah come make imself ruler for Judah. E try to kill anybody for the family wey suppose be king. E even kill any of im grand pikin wey e hand reach. Everybody come dey fear am.

High Priest Jehoiada and im wife Jehosheba, know sey wetin Athaliah dey do no good. Dem put their life for danger to save one of Athaliah grand pikin wey dem dey call Jehoash. Dem train am for temple.

When Jehoash reach seven years, Jehoiada gather all the Levite and the oga of all the bodyguard, and tell dem sey: ‘Make una guard the temple door, make una no let anybody enter.’ Na im Jehoiada put crown for Jehoash head and make am Judah king. People wey dey Judah come dey shout sey: ‘Make the king live forever!’

Queen Athaliah dey shout

Athaliah hear as people dey shout, na im e enter the temple. As e see the king, e shout sey: ‘Na plan work! Na plan work!’ The oga of the bodyguard come carry Athaliah comot go kill am. But what of the bad bad things wey e don make people dey do for Judah?

Jehoiada make dem promise Jehovah sey na only im dem go worship. Jehoiada tell dem make dem scatter all the juju temple and pieces all the juju. E choose priest and Levite wey go dey work for the temple make people fit worship Jehovah well again. E choose people wey go dey guard the temple make bad people for no enter. Im and the oga of the bodyguard come carry Jehoash go the palace and put am for im throne. Everybody for Judah come dey happy. Last last, dem fit serve Jehovah well because wicked Athaliah and juju worship no dey again. You no think sey the strong mind wey Jehoiada get help many people?

‘Make una no fear people wey go fit kill una body, but wey no go fit destroy una life. But make una fear the person wey go fit destroy una body and una life for Gehenna.’—Matthew 10:28

Question: How Jehoiada take show sey e get mind? You think sey Jehovah go fit help you get mind?

2 Kings 11:1–12:12; 2 Chronicles 21:1-6; 22:10–12; 23:1-24:16

    Publication for Pidgin (West Africa) (2017-2026)
    Log Out
    Log In
    • Pidgin (West Africa)
    • Share
    • How You Want-Am
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • Wetin You Go Do and Wetin You No Go Do If You Want Use This Website
    • How We De Handle Information for This Website
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share