Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Pidgin (West Africa)
  • BIBLE
  • PUBLICATIONS
  • MEETINGS
  • lfb lesson 3 p. 14-p. 15 par. 3
  • Adam and Eve No Obey God

Video no dey for wetin you select.

Sorry, the video no go fit play.

  • Adam and Eve No Obey God
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Other Materials Like This One
  • How Life First Be for Adam and Eve?
    Obey God and You Go Live Forever
  • Wetin De Happen to Person When E Die?
    Wetin Bible Fit Teach Us?
  • God Make the First Man and Woman
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 3 p. 14-p. 15 par. 3
Adam and Eve dey comot from the garden of Eden

LESSON 3

Adam and Eve No Obey God

Adam hold the fruit wey God sey make dem no chop wey Eve give am

One day wey only Eve dey the garden, one snake come dey talk to am. The snake sey: ‘Na true sey God no let una chop from all the tree wey dey the garden?’ Eve answer am sey: ‘We fit chop from all the tree wey dey the garden apart from one. If we chop from that tree, we go die.’ The snake tell am sey: ‘You no go die. Even self, if you chop from that tree, you go be like God.’ You think sey na true the snake talk? For where! That one na big lie. But Eve believe am. The more Eve dey look the tree, the more the tree dey enter im eye. E come chop from the fruit and still give Adam. Adam know sey if dem chop the fruit, dem go die. But e still chop am.

As Adam and Eve dey comot from the garden of Eden, two angel and one sword with fire dey guard the gate

Later that day, Jehovah come ask Adam and Eve sey why dem chop the fruit. Eve sey na snake, Adam sey na Eve. As e be sey Adam and Eve no obey Jehovah, e pursue dem comot for the garden. God come put angel and one sword with fire for the place wey them dey pass enter the garden, make dem for no enter again.

Jehovah sey e go still punish the person wey lie for Eve. No be the snake really talk to Eve o! Jehovah no make snake to dey talk. Na one bad angel make am be like sey the snake dey talk. E do am to deceive Eve. That angel na Satan the Devil. E no go tey, Jehovah go destroy Satan so that e no go fit dey deceive people to dey do bad things again.

‘The Devil na killer when e start and e no use im mind support the truth because the truth no dey im mind.’—John 8:​44, footnote

Question: Wetin make Eve chop the fruit? Wetin happen to Adam and Eve after dem chop the fruit? Who be Satan the Devil?

Genesis 3:​1-​24; John 8:​44; 1 John 3:8; Revelation 12:9

    Publication for Pidgin (West Africa) (2017-2026)
    Log Out
    Log In
    • Pidgin (West Africa)
    • Share
    • How You Want-Am
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • Wetin You Go Do and Wetin You No Go Do If You Want Use This Website
    • How We De Handle Information for This Website
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share