-
Twelve People Wey Hide Go Look CanaanLesson Wey You Fit Learn From Bible
-
-
LESSON 26
Twelve People Wey Hide Go Look Canaan
As Israel people comot from the mountain, dem pass the desert wey dey Paran go Kadesh. Jehovah tell Moses for there sey: ‘Send 12 men, one one from all the tribe make dem go hide look Canaan, the land wey I want give Israel people.’ Na im Moses choose 12 men come tell dem sey: ‘Make una go Canaan go look whether the land good to grow food. Make una see whether the people weak or dem strong and whether dem dey stay tent or dem get strong fence.’ Their 12 come start to dey go, Joshua and Caleb dey among dem.
After 40 days, their 12 come back with different different fruit. Dem sey: ‘Na good land, but the people strong and their city get high fence.’ Caleb come sey: ‘We go win dem. Make we no waste time at all!’ You know wetin make Caleb talk like that? Na because im and Joshua trust Jehovah. But the other ten people sey make dem no try am because the people “grab like giant.” Dem still sey dem be like ant for their front.
Israel people come weak. Dem come start to dey complain to theirself sey: ‘Make we choose another person wey go carry us go Egypt. Why we go go die for that place?’ Joshua and Caleb tell dem sey: ‘Make we obey Jehovah and make we no fear. Jehovah go protect us.’ But Israel people no gree hear word. Dem even want kill Joshua and Caleb.
Wetin Jehovah come do? E tell Moses sey: ‘After everything wey I don do for Israel people, dem still no want obey me. Dem go stay desert for 40 years and dem go die for there. Na only their children, Joshua and Caleb go stay the land wey I promise dem.’
‘Wetin make una dey fear, una wey get small faith?’—Matthew 8:26
-
-
Dem Challenge JehovahLesson Wey You Fit Learn From Bible
-
-
LESSON 27
Dem Challenge Jehovah
After some time wey Israel people dey the desert, Korah, Dathan, Abiram and 250 other people challenge Moses. Dem tell am sey: ‘Una own too much! Why e be sey na you be our leader and Aaron na our high priest? Jehovah dey with all of us, no be only you and Aaron.’ Wetin dem talk no make Jehovah happy at all. E take am like sey na im dem dey challenge.
Moses come tell Korah and the people wey dey follow am sey: ‘Make una come tabernacle tomorrow and make una full una stick wey fire dey with incense. Jehovah go show us who e don choose.’
True true, the next day, Korah and im 250 men go meet Moses for the tabernacle. Dem come burn incense like sey dem be priest. Jehovah come tell Moses and Aaron sey: ‘Make una comot for where Korah and im people dey.’
Na true sey Korah go meet Moses for the tabernacle, but Dathan, Abiram and their family no gree go. Jehovah come tell Moses sey make dem no near Korah, Dathan and Abiram tent. Na once all Israel people comot. But Dathan, Abiram and their family stand for front of their tent. Before dem know, ground open swallow all of dem. Fire come down from heaven come burn Korah and im 250 men for the tabernacle.
Jehovah come tell Moses sey: ‘Take one one stick from the leader of all the tribe and write their name put. But write Aaron name for Levi tribe. Put all of dem for inside the tabernacle, and the stick of the person wey I choose go grow flower.’
The next day, Moses bring all the stick come out and show dem. Flower don dey grow for Aaron own, and ripe fruit dey on top am. This one show sey Jehovah don choose Aaron as high priest.
‘Make una dey obey people wey dey lead una and make una dey carry unaself down.’—Hebrews 13:17
-