Suffer Suffer Go Fit End?
You go talk sey . . .
yes?
no?
e fit?
SEE WETIN BIBLE TALK
God go dry all the water wey dey comot for their eyes, dem no go die again, dem no go even cry because of sey person die, trouble and pain no go dey again.’—Revelation 21:3, 4, New World Translation.
HOW WETIN BIBLE TALK FIT HELP YOU
God no get hand for all the wahala wey dey worry us today.—James 1:13.
Our mind go rest when we no sey God dey pity us when we dey suffer.—Zechariah 2:8.
Make you get am for mind sey suffer suffer go end.—Psalm 37:9-11.
WE FIT BELIEVE SEY WETIN BIBLE TALK NA TRUE?
Yes, make we see two reason wey go make us believe:
God no like as we dey suffer, e hate partial. Think how e do Jehovah God for body when im people Israel see pepper for other people hand. Bible talk sey ‘e pain God well well as im people Israel dey suffer.’—Judges 2:18, New World Translation.
E dey pain God for mind well well when e dey see the bad bad things wey some people dey do other people today. Na wetin make Bible talk sey God hate ‘people wey dey kill people wey their hand clean.’—Proverbs 6:16, 17.
Na better thing God want for all of us. Na true sey everybody sabi ‘im own wahala and the thing wey dey spoil im belle,’ but Jehovah sabi am pass am.—2 Chronicles 6:29, 30.
Jehovah go use im Kingdom comot all the wahala wey dey worry us. (Matthew 6:9, 10) But now, Jehovah dey sofri sofri make the mind of people wey dey find am sweet well well.—Acts 17:27; 2 Corinthians 1:3, 4.
MAKE YOU THINK ABOUT THIS QUESTION
Why God allow us dey suffer?
Bible answer this question for ROMANS 5:12 and 2 PETER 3:9.